⏫ Top 5️⃣ 0️⃣ Amazing Funniest African Words

1,Na person wey never see problem dey use English dey pray.

2,Book wey nor wan enter head go enter exam hall.

3,Goat wey get mind follow lion go catch fish,make e know say weda dem catch fish or not,lion food don set.

4,Who naked nor dey chuck hand for pocket.

5,Wetin concern dog with family planning.

6,Na determination dey make okada overtake trailer for road.

7,This one good, this one good na em mad man  take dey gather plenty load.

8,Pikin wey go strong go strong nor be say until dem name am Samson.

9,Na over confidence make February nor complete.

10,Do you know who I am,do you know who I am ?.Naso hold up take dey start.

11,Head wey nor wan think go carry load.

12,Hand wey stay long for pocket,know say nothing dey that pocket.

13,Forget trust if trust dey,water nor for boil fish.

14,No matter how lizard do press up reach,e nor fit get muscle pass crocodile.

15,E dey clear pimples, e dey clear pimples, na so bleaching start.

16,Feel at home,feel at home,Na em dey make visitor spoil remote control.

17,Escort me,escort me, Na so slave trade take start.

18,It's a small world nor mean say you fit trek from Naija go London.

19,Christianity is free but you must buy bible.

20,Person nor dey use shame chop winch oo.

21,Make I chop this guy,make I chop this guy,Na so ashawo take start oo.

22,You nor need spoon and cutlery to chop slap.

23,Jollof rice wey dey for bottom of pot today go dey for top of cooler tomorrow.

24,The patient dog,...nah hungry go kill am.

25,I go do am later na em make fowl nor fly like other bird.

26,No food for lazy man nor be for person wey em mama get restaurant.

27,I am covered by the blood of Jesus ,e nor mean say make you nor lock door sleep oo.

28,Who dey owe landlord rentage nor dey fry stew wey curry dey.

29,Pastor wey dey pray for mad person nor dey close eye.

30,I wan marry,I wan pikin,I need money,Na em make church overflow dey full.

31,I know too much, I know too much, Na em make SAN nor fit recite National anthem.

32,I know book, I know book Na em make you dey say merit instead of advantage.

33,The thing wey make egg strong for pot,na em make yam also soft.

34,Pikin wey say em mama nor go sleep,em self nor go sleep.

35,Sun too hot  ,e nor mean say fowl go lay boiled egg.

36,Monkey smart,monkey smart,na because tree near tree.

37,Na run wey nor serious,na em woman dey hold breast.

38,Na cooperation dey make rice full pot.

39,Cockroach wey say em sabi acrobat dance where cocks are doing general meeting don waka kurukere waka.

40,Say lion dey sick nor mean say em with cat na mate.

41,This burial rich,this burial rich,na em make die hungry elders.

42,We go make am,we go make am,na em make village dry,Lagos full.

43,Na economy recession make teacher use ruler measure yam.

44,Pikin wey wan chop party rice,em nor dey fear dance.

45,Say cat sabi swim nor make am catfish.

46,E go better, e go better,na em make slippers get size.

47,Park there,where you dey go,na so road block become toll-gate.

48,Fish wey scatter for soup still dey inside the soup.

49,I never ready,I nor need love,na money I want,na so sugar daddy and mummy take start.

50,This writeup sweet,this writeup sweet,nor mean say you nor go tell your friends make you friends laugh join.

Comments

Popular posts from this blog

SEE WHY GOVERNMENT IS FIXING PIPES IN EVERYWHERE IN MOST STATES

SEE THE REASON WHY YOUR BODY ITCH YOU AFTER TAKING YOUR BATH

Naira Marley fined after lockdown concert